Nothing do me!!!

I don dey try write dis thing for pidgin...but e be like say e fit no work o...
Na wetin sef...I sabi yarn the thing but to come drop am for paper come dey hard like olumo rock!...mschew...
Anyhues BabaGod sef sabi say I dey thankful and im praise go everly dey for my mouth.
How una dey?hope say una dey kampe...work don nearly finish person for here but dem no fit jo!
I too much for all their wahala...make dem bring am come...omo girl go withstand am...nothing do me by His grace!
I no too get gist...infact I no get gist for una...e get one book wey I read yesterday..."half of a yellow sun"...chei...I been cry o as I read the book...na the second book wey go comot tears for my eyes be that... the first one be "what is wrong with being black" by Matthew Ashimolowo...
Na the kain book wey go make you pause...SELAH...
Anyways I no wan yarn too much paparrazi for here...I go still do the thankfulness post as usual...but I just say make I hail my peops...make e no be like say...:-)

P.S
GNG see if you fit decode this post...lol!!!

Comments

Zoe Believer said…
First of all, i love your blog. Secondly, norrin do you jare! Abeg stand tall, no limit on the possibilities wey Baba God go throway your side...
.. said…
I hear half of a yellow sun is a great book.Unfortunately,i've read only purple hibiscus.

Take it easy at work,and finally,
Nothing do you jo!
NoLimit said…
Yay!!! thanks believer...you sure know how to make a gal's head swell(kai how will I translate this to pidgin o....)
You sabi make person head swell o!I gree with you jare...my God dey unlimited wetin wan come limit me?:-)

Rose...I haven't actually read purple Hibiscus o...but I tell you half of a yellow sun was IT!
In line with pidgin day...I go try take am easy...but make dem sef no try me lol!
Rebirth said…
everyone seems to like half of a yellow sun.... off to go look for it
Toluwa said…
okay, so u lost me! i cannot understand that post. I love to hear it, but reading it? nah! i'll come back for he thankfulness post!
Anonymous said…
You'll be so proud of me, NoLimit: I understood about 95% of it! My big question is what does "Nothing do you/me" mean? I think it's clearly meant to be a complimentary almost like a "You rock!" sort of sentiment but I don't know for certain.

Also "yarn paparrazi"? Yarn I know, but in conjunction with paparrazi?

Do explain!

I hope you're having a great week!
Anonymous said…
ooooooooooook...I dont know alot of pidgen...but I got the point


First time here....how you dey
Writefreak said…
Yes my person nurrin do you!

Half of a Yellow Sun is a brilliant piece! I couldn't put it down!

This your pdgin wan scatter my head!
Vera Ezimora said…
LOL!

So GNG understood everything except Nothing Do Me???

Hahahahaha. Una no go kill pesin with laffta.

Ehm.... Na only 2 books you don cry 4? I think I cry 4 most books I read.
Olufunke said…
You try well, wll for the language you take write this post.
and since people like GNG could even understand most of it, I doff hat for you.
I am yet to read half of a yellow sun, but I have heard good things about the book, woudl try to read soon.

How are you doing?
nothing do you for real! lemme go and read the rest of ur blogs
Roc said…
Haven't read it as well..!!
Was only just saying this morning how I don't read books like I used to..

@ GNG.. To yarn paparrazi means to yarn opata...
LOL.. Hope that helped?!
SOLOMONSYDELLE said…
nothing do you, shebi? Except book wey dey make you cry. Pele oh!

I hear it is an excellent book. I hope to read it someday.

Have a fabulous weekend!
Emeka Amakeze said…
The reading culture is gradually dying but i still get my kicks out of reading quality books. I will check out this one.
Geebee said…
Nothing do you jare. . O lenu bi kettle i.e. You get mouth like kettle. Yeah some books have that kind of effect on you especially if the writer expresses the contents in a superb manner. Chimamanda sure knows her stuff. I'm yet to read Half of a yellow sun though but i read Purple Hibiscus
Giagerry said…
mehn...its hard to read!
my Gawd i suck at ibo as if thats not enuf for me, i now suck at reading pidgin...not kul!
kool blog still!
Bibi said…
half of a yellow sun huh? i'll go look for it. nice blog
NoLimit said…
Awww thanks all,will be back right after I put up my thankfulness post to respond individually...
Buttercup said…
lolololol u made pigdin sound sexy..lol!

i need to read this book too..

Popular posts from this blog

You're not a tree... make that move!

Thankful Saturday V6

Re: In The Name of All Things Men.